Court done close for vacation today, Friday. If dem catch you now, just know say na next year you go see outside🥺! You fit chop Christmas rice and New Year chicken for cell o🧑✈️! Abeg, behave yourself, avoid wahala/trouble, and if person wan drag matter, just waka dey go.If person step on you, say sorry join.No go do “big man” for road, ooo😜!
This period no be time to flex big man or form stubborn. Stay low-key, waka jeje, and secure yourself ooo😊! Wahala no dey ever finish, so no go look for am. Stay safe ooo!
I just dey talk my own because I love everyone oooooo
